Popular Posts

Total Pageviews

Powered by Blogger.

Popular Posts

RSS

GENERAL - PIDGIN ENGLISH LAUNCHED IN WARRI CHECK OUT THE ASSUME PSALM 23 IN PIDGIN

The Holy Bible "Pidgin" Version was launched just days ago in warri. Here is an assume copy of Psalm 23. Read and Enjoy

PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH
1. The Lord na mai Shepherd, I dey kampKe
2. He make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi Thermacool.
3. He panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness for sake of Hin Name.
4. Walahi! If I waka pass where arm robber, 419, and juju people borku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so them dey like back bone dey comfort me.
5.You don prepare Banga and starch make I chop. All my enemies dey look anyaya. You rob me for head wit Vaseline Intensive Lotion. My cup na Ogunpa River wey come overflow hin bank.
6. True, true, betta life & mercy go gum my back till I quench. And man go tanda for God house sotey sotey from Lai lai to lai lai. GOD ALMIGHTY, NA YOU BIKO. AMIN!!

  • Digg
  • Del.icio.us
  • StumbleUpon
  • Reddit
  • RSS

0 comments:

Post a Comment